as ASUU don call of strike, i go gladly do all the whole chores today, wash car, wash tiles, run errands, kiss kiss and laugh with my parents cause once i commot this house omo, them fit no see me till thy kingdom come
kilishi for one plate, sugar cover the garri, groundout surplus, you even get enough light to create Ice blocks, still even put am for tray, tattoo for wrist, con snap the picture with IPhone. Please just stay where you are, EFCC is on the way
be like person go start dey battle odour with words of affirmation
“I will smell nice today”
“my armpits are blessed”
“I step out with the scent of the Lord”
😂these takes dey always funny me cause e no get wetin you wan talk my bro or how you wan talk am, if you like do podcast, or drop album, come rain, come sunshine, come hail, I go serve baba God for the rest of my life
unrelated but for secondary school you go run this kain soakis for deep midnight when you think sey everybody dey sleep, nobody go talk anything as you dey mix am oh, na as you wan take 1st spoon you go hear “abeg I fit base” 😭