Myror Profile
Myror

@MyrorMiller

Followers
1,214
Following
1,649
Media
904
Statuses
12,210

Ask me if it’s that important to you..

London, England
Joined April 2010
Don't wanna be here? Send us removal request.
Explore trending content on Musk Viewer
@MyrorMiller
Myror
1 year
@realFFK You no get Tinubu number? No be your guy? Call am for phone tell am, no dey disturb us abeg we dey focused on #AllEyeOnTheJudiciary
113
132
2K
@MyrorMiller
Myror
10 months
@Naija_PR The guy don chop her already for Lagos and nah continuation wan go happen for Abuja so..
66
28
1K
@MyrorMiller
Myror
9 months
@yabaleftonline E fit be your sister or family member tomorrow. But make we talk truth, dem get many girls wey no go date you unless you be Yahoo boy..
50
14
791
@MyrorMiller
Myror
1 year
@RealOlaudah At this point now, nah hin followers him dey try hide things from, people wey get sense already know say everything about the man get comma inside..
14
52
761
@MyrorMiller
Myror
11 months
@instablog9ja Nah people wey no know him story all the way from Peckham go dey surprised, the guy criminal record dey for public space like Tinubu own. But for Nigeria we go accept people as normal once dem don fit make money..
21
53
667
@MyrorMiller
Myror
11 months
@KadunaResident When the head of the drug cartel nah the president of the country, where we wan start from?
12
59
657
@MyrorMiller
Myror
11 months
@DailyPostNGR Nah one vote him get. If the system dey work, one man no go ever fit tell the other say e no fit be president as long as him live. You get power to make person president and you no fit make Atiku?
41
7
506
@MyrorMiller
Myror
1 year
@GUnderground_TV If Nigeria joins and ask for loan, please don’t give us, our politicians will share it with your friends..🙏🏿🙏🏿
43
34
426
@MyrorMiller
Myror
11 months
@PIDOMNIGERIA Even Peter Obi know say him no get say for this matter when e start, him fit decide to continue for court, but the people go enter streets, and if e mean to shutdown the whole country for however long e go take, the people no send..
10
41
406
@MyrorMiller
Myror
1 year
@The_Korede Pay for gate, pay for seat, pay for tent and then the food go expensive and no make sense, drinks overpriced. To go beach for Lagos nah stress on it’s own
5
13
410
@MyrorMiller
Myror
10 months
@instablog9ja The Pastor 2 odds don enter, him taking time don reach..
6
7
370
@MyrorMiller
Myror
1 year
@UchePOkoye Even if you say make you do am for some communities for free, the area boys go still charge you money to run am..
15
18
348
@MyrorMiller
Myror
1 year
@yabaleftonline That one concern you, even if you like give us IGP number, we go still bring the matter come social media since una no dey hear word..
2
8
341
@MyrorMiller
Myror
1 year
@instablog9ja Him dey speak for him and him brothers, no man born of a woman go tell me how to enjoy my woman..
39
3
327
@MyrorMiller
Myror
1 year
@teejaybaba @jacksonhinklle You go explain tire, you think say the world no know wetin dey happen for Nigeria? No be everybody dey get their news from Whatsapp group like you and your family members..
8
6
310
@MyrorMiller
Myror
11 months
@instablog9ja Wait who dey surprised say Olamide dey sleep with other women? If you dey surprised then you no be Nigerian..
9
5
306
@MyrorMiller
Myror
1 year
@mrlurvy The people wey respect her before still respect her till date. You no kuma like her before so we know..
11
5
302
@MyrorMiller
Myror
11 months
@instablog9ja Make I hear say Portable go perform anybody for free. Portable wey dey vex for Adekunle Gold say e no ask for feature but dey ask for free dance challenge. Una fit lie to una sef no be we..
3
10
290
@MyrorMiller
Myror
1 year
@XBrianDennis Your vote nah still one and nah who you like you go give am..
1
1
278
@MyrorMiller
Myror
1 year
@ruffydfire Nah small time remain, this games dem dey play with Nigerians don dey near the end. #AllEyesOnTheJudiciary
15
22
264
@MyrorMiller
Myror
1 year
@yabaleftonline If no be say NBA no serious or get important things to do, wetin concern them with her lifestyle? NBA nah cult? Una leave Keyamo and co wey dey disgrace una profession dey chase person wey dey live her life..
9
0
255
@MyrorMiller
Myror
10 months
@channelstv Go ye into the North and multiply..
21
6
256
@MyrorMiller
Myror
10 months
@instablog9ja The problem with Blessing be say she don too dey used to fake life and no fit understand why person go happily they live him life without faking..
7
9
234
@MyrorMiller
Myror
10 months
@DavidHundeyin These people no dey learn, person wey no dey chase una, una dey poke am for every corner..
2
10
242
@MyrorMiller
Myror
11 months
@GazetteNGR Nah the same people dey there but all the same make Obi still go till the last to show him believe for rule of law and how institution suppose function. At least him don open the judiciary yansh to the world like this..
8
11
241
@MyrorMiller
Myror
1 year
@Mrbankstips Wetin oil money no fit do? Somehow dem go manage to pull am though, when dem make UEFA the offer dem no fit reject, dem go create space for dem.
6
3
221
@MyrorMiller
Myror
1 year
@Orji_Okosisi1 After dem disqualify am nah to lock am for him crimes and all the people wey dey involved for the state capture also go need go jail follow the matter, nah then justice go complete. #AllEyesOnTheJudiciary
9
18
229
@MyrorMiller
Myror
1 year
@instablog9ja Him write 150 Naira, @instablog9ja where you see your own 150K?
10
3
231
@MyrorMiller
Myror
11 months
@General_Oluchi Any re-run with Tinubu for the ballot no go stay. Justice no go complete until dem disqualify, arrest and send Tinubu and all the people wey put Nigerians through these months of pain and hardship to jail. Everybody, Keyamo, FFK and Dele Alake need special jail where dem go only
9
24
220
@MyrorMiller
Myror
9 months
@Jack_ng01 Where the lie here? Even Nigerian families dey advice their people abroad not to visit Nigeria..
5
3
221
@MyrorMiller
Myror
9 months
@UchePOkoye The policy after the war did as much damage if not more than the war itself..
4
10
208
@MyrorMiller
Myror
1 year
@osasuo @Arsenal @Hyatt Sadly, not many Nigerians dey aware of how much of a super power Nigeria suppose be if say the looters go do even half of the job dem dey there to do.
10
14
210
@MyrorMiller
Myror
10 months
@GazetteNGR For the people wey read only headline and fit vex say him 'blast' Hausa community leaders, nah wetin dem talk be this; “The position of the government is that the market will no longer be residential because key performance indicators have shown that there has been no kidnap
10
13
200
@MyrorMiller
Myror
10 months
@instablog9ja People wey dey vex for the man for helping them again, una be Christians at all?
8
3
190
@MyrorMiller
Myror
1 year
@Mario9jaa If dem join the protest una go say dem wan collapse Nigeria, dem still dey face their own problems una still dey find them, wetin Southeasterners do una?
8
3
190
@MyrorMiller
Myror
1 year
@numberonetweep Nigeria people sha, so of all the problems for Nigeria so nah this one dey bother you? You need help I swear..
7
0
192
@MyrorMiller
Myror
11 months
@AfricaFactsZone Then Africa had leaders, now what we have are group of Kleptomaniacs masquerading as leaders..
5
9
191
@MyrorMiller
Myror
10 months
@instablog9ja Nah because for real world, who no sabi book still sabi make money..
1
0
178
@MyrorMiller
Myror
1 year
@yabaleftonline Nah the person wey edit the picture do the surgery, the person really sabi work..
7
0
180
@MyrorMiller
Myror
1 year
@Wasiuagboola200 @realFFK Do you know the Chairman of ECOWAS? Do you know the biggest decision maker in ECOWAS, since nah you know pass..
9
3
175
@MyrorMiller
Myror
9 months
@yabaleftonline Over 2,000 contestants wey gather to pick this $1 bill of $1M no single person injure. Try am for Nigeria the amount of casualties go be something else..
4
1
178
@MyrorMiller
Myror
1 year
@yabaleftonline Still let am bite small nah, why you dey treat am like how Nigeria politicians dey treat the people?
6
0
175
@MyrorMiller
Myror
11 months
@General_Oluchi For Atiku, instead Tinubu will steal the election from Peter Obi and he become the loser, it's best to scatter everything so Tinubu will join him on the loser corner, they all know who won the election.
2
9
173
@MyrorMiller
Myror
1 year
@chude__ The hope still dey very much alive..
0
0
163
@MyrorMiller
Myror
10 months
@instablog9ja Him no lie, the millions dem dey win every week no be small and I don play all their games tire and never win any, even on the day dem say dem win wey I play the same games, nothing dey come, not even cut 1..
15
5
152
@MyrorMiller
Myror
1 year
@PoliceNG Una no fit condemn the act because nah so una be, nah to use this excuse to get the guy for using him art to expose una for wetin una be..
2
5
161
@MyrorMiller
Myror
11 months
@instablog9ja We sha like to pretend for Nigeria, who go say somehow him no dey get dealings with Yahoo boys? Dem be your neighbors, your customers, dem dey date your sisters, dem dey do charity, dem dey go your churches and mosques, una dey do things together..
17
8
156
@MyrorMiller
Myror
1 year
@realFFK Okay since you and Tinubu dey quarrel and you no fit reach am for phone, call your fellow fake News merchant Keyamo and tell am to help you pass the message to Tinubu abi you don quarrel with that one too?
8
6
155
@MyrorMiller
Myror
1 year
@urchilla01 Akpabio dey fear to touch Obi, make e no come deliver am from spirit of corruption..
26
12
145
@MyrorMiller
Myror
11 months
@ReporteraNews If him like make him unleash the Army, Amotekun, Navy, Issabaka and all, him go leave that position for sure, Imo people must dey free from this evil..
11
9
149
@MyrorMiller
Myror
10 months
@DAMIADENUGA Toyin Abraham no even fit breath inside this outfit, who sent her?
1
1
147
@MyrorMiller
Myror
1 year
@Norbert011 @AishaYesufu Really? Nah so you reason am? Nah she be your president? Which position she dey for government or military to go rescue people from kidnappers? Guy still dey use your head small nah..
7
1
148
@MyrorMiller
Myror
11 months
@UchePOkoye The only people for Nigeria wey dey wear uniform and not oppress people nah primary and secondary school children. From NYSC go reach the highest uniform wearing people from Nigeria, dem go oppress you sha ni..
7
17
133
@MyrorMiller
Myror
11 months
@yabaleftonline Once dem start to cry, know say dem want make you give up on the right thing and listen to their emotions instead..
7
4
137
@MyrorMiller
Myror
1 year
@FirstObidient We dey here and we dey follow back @MyrorMiller and @Teewestman
2
2
129
@MyrorMiller
Myror
11 months
@Drelmoatiku @ChicagoState If no be the school delete am, then Tinubu don pay people to hack the site, nothing wey drug dealer no fit do to cover track..
1
12
119
@MyrorMiller
Myror
10 months
@instablog9ja For people wey like ask, to brick the phone mean say Apple use their software permanently damage the phones, dem no fit work for life even if you bring am to your guys for computer village..
9
5
121
@MyrorMiller
Myror
1 year
@anto_v25 @ManUtd All the best my Captain
0
0
126
@MyrorMiller
Myror
1 year
@General_Oluchi Nah so dem dey score own goal on a daily, now the awareness dey spread pass as dem like, too late to quench the fire.. #AllEyesOnTheJudiciary
0
7
124
@MyrorMiller
Myror
10 months
@instablog9ja E good, and the thing be say e no get as e be, many of them dey among the people wey dey support the chief forger for Aso Rock..
10
2
120
@MyrorMiller
Myror
9 months
@Abiso_la Don Jazzy don run the 6M ✊🏿✊🏿
1
0
117
@MyrorMiller
Myror
9 months
@SaharaReporters Only fish? Even as things bad like this, if APC still go the market to campaign, dem go still happily vote for them because nah their own person and cost of living no know your language...
1
3
119
@MyrorMiller
Myror
11 months
@instablog9ja Since Adidas no gree do him shoes again, him no wan wear any other brand until him start dey produce him own shoes again..
3
3
112
@MyrorMiller
Myror
1 year
@MobilePunch Why DSS, wetin be Police work? Oh I forget, dem dey to harass and intimidate regular Nigerians for every corner..
5
2
114
@MyrorMiller
Myror
1 year
@MissPearls Nah block I dey block dem, no time..
3
3
109
@MyrorMiller
Myror
10 months
@yabaleftonline Still no video evidence, if the penis no longer dey there, wetin him dey hide?
11
3
113
@MyrorMiller
Myror
1 year
@fisayosoyombo Normal Nigeria police way, once you don enter their station, dem must rob you..
2
6
112
@MyrorMiller
Myror
1 year
@DavidHundeyin Dem dey the same category, only say Mercy Akide nah Asisat Legend..
3
0
111
@MyrorMiller
Myror
1 year
@rutie_xx Him wife write you to complain?
4
0
109
@MyrorMiller
Myror
11 months
@AishaYesufu Instead dem go change the AU Constitutive Act to accommodate them and even give them high office for AU..
0
6
112
@MyrorMiller
Myror
10 months
@instablog9ja Collect the keys and drive the car to carwash and go pick am up later..
10
1
108
@MyrorMiller
Myror
10 months
@FirstObidient Like for follow, and abeg follow back..
1
0
102
@MyrorMiller
Myror
11 months
@GazetteNGR Atiku, you need go collect your money back from Reno, and give am many dirty slaps for him carry talk..
11
4
103
@MyrorMiller
Myror
11 months
@SaharaReporters Exactly, begging them to obey court order nah to show the level of impunity we dey accept for Nigeria, if no be say nah Nigeria nah banana republic, why court go release person and DSS still hold am?
2
16
104
@MyrorMiller
Myror
1 year
@Equityoyo So if I go market now and price of things never fall, sheh make I tell them say dollar price don fall by N200 in 24hrs and say nah Tinubu hand work and for that make dem sell cheaper for me?
7
4
104
@MyrorMiller
Myror
11 months
@PulseNigeria247 Pick plus the calabash to keep for house in case more appear..
21
0
105
@MyrorMiller
Myror
11 months
@instablog9ja If you think say you go fit settle husband and wife after 15yrs, good luck with that. The woman dey better off without that man abeg, the man no solid..
12
1
100
@MyrorMiller
Myror
10 months
@MobilePunch No be like Lagos wey dem go use touts chase you comot and destroy your property..
6
1
92
@MyrorMiller
Myror
1 year
@FirstObidient We full ground. Abeg make una follow me, I dey follow back. @MyrorMiller and @Teewestman
5
1
96
@MyrorMiller
Myror
10 months
@FirstObidient Like for follow..
0
0
96
@MyrorMiller
Myror
1 year
@BOGbadams We dey wait to see how him slaves go defend am when dem finally release the records. I sure say by now dem go don dey strategize on how to go about am..
7
5
90
@MyrorMiller
Myror
1 year
@fkeyamo @YouTube We no dey surprised say you no know where you come from, the person wey give you the portfolio sef we no know where him come from, even you sef no know..
17
6
100
@MyrorMiller
Myror
10 months
@instablog9ja Case closed, I go use your wig money buy new mattress
4
0
95
@MyrorMiller
Myror
1 year
@abdullahayofel Person wey support drug lord wey forge every document wey get him name on top dey vex for piracy? Really?
26
3
97
@MyrorMiller
Myror
1 year
@AbdulMahmud01 No mind the yeye people, which government be Buhari government? No be the same APC? Ajuri dey speak many English, sheh nah wetin I wan explain to danfo drivers and conductor when I dey argue with them on cost of transportation? #AllEyesOnTheJudiciary
2
17
98
@MyrorMiller
Myror
11 months
@GazetteNGR So for Tinubu mind now him get image to protect? Person wey for just dey enjoy him retirement like this, you say you must be president, see your life outside now..
4
5
93
@MyrorMiller
Myror
11 months
@akinalabi We go see where e go end las las. All of una go surely pay when the time come.
3
3
95
@MyrorMiller
Myror
1 year
@kc_journalist @woye1 And for Lagos, some group of people wey dem don swear for dey justify the increment for schools for the state..
11
4
94
@MyrorMiller
Myror
1 year
@BashirAhmaad Una funny sha, person wey him house dey on fire wey dey chase rat. Sheh Democracy dey Nigeria ni?
2
1
82
@MyrorMiller
Myror
10 months
@cctvidiots Fight back, even if you get beaten, it won't be as bad as not fighting back.
4
3
95
@MyrorMiller
Myror
1 year
@abdullahayofel Shege from how much to how much? Sheh the people wey dey sell for road side also dey quiet? Sheh the price of things dey reduce for market? Una don mental I swear, all of una and e no go better for una..
7
1
84
@MyrorMiller
Myror
1 year
@yabaleftonline Where the meal? This one nah skeletons and other parts of animals dem display for museum..
3
0
89
@MyrorMiller
Myror
1 year
@General_Oluchi Dem don buy market and dey feel the heat.. #AllEyesOnTheJudiciary
1
7
84
@MyrorMiller
Myror
1 year
@MrAbuSidiq Which point you dey try to make? You say this is not journalism, you wan teach am him work ni? Channel your energy on how the document take reach him hand..
3
0
91
@MyrorMiller
Myror
1 year
@mrlurvy @PeterObi Talk direct to your president or you kuma take him phone type wetin you like read. On a normal, you sef know say you and Obi no dey on the same level, but dey there dey play..
2
1
86
@MyrorMiller
Myror
1 year
@kokomatic @Collynzo1 @Nayooomee1 So sexual assault/harassment on a woman in broad day light no concern am because nah Igbo? When you wan get sense?
4
0
82
@MyrorMiller
Myror
10 months
@WarriWeirdo @yabaleftonline This thing you write now make any sense? If you dey see am physically then how e take dey missing?
8
1
88